Listen

Description

Nigeria Police Force don arrest some people wey dey do “we no go gree “ waka for Lagos unto increase for petrol price and electricity tariff.

Dem arrest dem around Ojuelegba area of Lagos on Thursday.

Tori be say apart from the people wey dem arrest, dem sgtill carry materials of news people wey dey where e happen.

One of the people wey lead the group say na 18 person dem arrest and 4 news people dey inside.