Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) don announce 180 new COVID-19 cases for inside the country
This one na the latest development as dem say the total number of the sickness wey dey d country now na 64,516 and na 1,162 people don die from d sickness.
For the cases dem, Lagos get 74; Oyo, 41; FCT, 19; Kaduna, 19; Bauchi, 12; Ogun, seven; Rivers, four; Cross River and Edo get two each.