As Nigeria dey mark dia 60 years anniversary, Kaduna state governor, Nasir, El-Rufai dey advoctae for new national agreement.
E say dis one na for the nation collective goals, ontop citizenship, rule of law, diversity, merit, governance, and how powers and responsibilities fit go round between states and federal goment for wellbeing of the country.
Oga El-Rufai tell Nigeria people say dem go need dey confident and hopeful say dem fit make the country dey alright again.