Senate plus Federal Government disagree on the N5 billion bailout wey dem approve for airline operators and other businesses inside the aviation sector to reduce the impact of COVID-19 pandemic for dem operations.
Senate ask Federal Government to increase the bailout fund,dem say e too small, Federal Government say dem no fit go pass that amount, as dem get other challenges to deal with.
Chairman, Senate Committee on Aviation, Senator Smart Adeyemi, say e dey important for dem to review the bailout funds for airline operators, cos Wetin d government dey offer as bailout dey too small to make any meaningful impact.