Lagos State Attorney-General and Justice, Commissioner Moyosore Onigbanjo (SAN) don yarn the courts to sharpaly free 253 persons wey police arrest bcos of the #ENDSARS protest inside the state.
Oga Onigbanjo yarn say the Directorate of Public Prosecution (DPP) for inside d state don chook eye put for d temprorary charges wey police file against dem and dem no see any evidence say dem commit any crime.