Listen

Description

A cry to my heavenly father to reveal himself through me to the world.

Let him give me the strength to go through this, for if he does not take it away from me, 

I am sure he will bless me through it.

BABA II

Baba, a don cam again 

A don cam wetti pain 

A don cam with plenty stain 

A need you, for make am, make e rain  

Dem di stay na economic war 

Dem di say na 5G, fifth generation star 

Dem di say na plan fo put chips fo ma body  

So dat a no fit go or thing far 

Some di daso tok say na punishment for we bad dem  

But Sar,

 A no say if you want beat me for ma bad dem, a go die

 A no go fit live 

A no say you like me too much daso fo knack me 

A no say if you no take this pain trowey, na daso yi you go use am bless me  

Whether na wetti di happen  

Whether na wetti a do am 

Daso now baba bring heaven Fo dis hell wey a de so di ya bad  

Cam baba, 

Cam  Show di pipo say all thing na ya own 

Show dem say no man no get right for touch ya picture 

Cam baba, cam show ya nature   

Mottanni, 2020