Sabi Nation, we thank una for all the calls, comments and questions wey una don send to us... we thank our sisters, Teju from Baltimore, and Blossom from Atlanta all the way from America, Esohen we thank yu but you no tell us wia yu dey call from, our sister Bunmi from Ibadan Nigeria we see yu too, we answer your question for the notes of this episode, our Salone Sister, Isata we thank you o we love the sweet sierra leone flavor of pidgin wey yu sama give us... Our brothers Isreal from Canada and Ejiro from Vienna Austria... we appreciate all of una... una do well...
Esohen, Bunmi, as per una question; ontop the episode,we put links to many research wey different scientists don do, plus including theory and practical, if una check am well, una go see sey even the pipo wey talk sey e work, dem no declare am as cure instead dem tell us how dem take do am wey e take work for the few pipo wey e work for. Las las wen all of dem compare numbers dem don see sey pipo wey e work for nor many and na pipo wey d koro neva turn chairman for dia bodi.
Sabi Nation, to leave us message nor hard o, just go ontop any of our social media platforms;
Facebook: How Una See Am Podcast
Instagram: @officialhusapodcast
Twitter: @HusaPodcast
YouTube: How Una See Am Podcast
Or call our number +1 (240) 459-8364 leave ur comment for voicemail, or use dis link https://wa.me/qr/ZYXR5W3OAUFWL1 add us to WhatsApp and send voicenote. We wan hear from una.
**Music Credits: UNITY by HUSAPodcast, YellowFela Production